Information reaching Kossyderrickent has it that popular Nigerian kayanmata seller, Omoshola’s Place Empire is currently on the run after borrowing millions of Naira from aboki (Hausa money men). (Read More Here).
Taking to social media, a popular blog, Gistlovers, revealed that Omoshola had borrowed money from Aboki through the help of Instagram big girl, Abdushally.
According to the blog, Omoshola had no collateral before she borrowed the N15M from the aboki. Now, the aboki is currently disturbing Abdushally for his money and at the same time, Abdushally, is disturbing Omoshola to pay her debt of N15M with N3M interest (Total – N18M) to the aboki.
Gistlovers wrote:
“Hello tueh tueh , otun zeh ooo🤦♀️Instagram millionaire in the poto poto ooo, I keep ringing it in Legit hustlers ears, you are doing well, keep pushing, don’t be distracted by Audio noise on Instagram, them plenty on the gram,all these girls go as far as taking money from all these aboki wey Dey change money just to make videos, some go even flaunt fake currency just to pepper legit hustlers on here, mumu legit hustler sef go Dey shout God when, God when what? You no go zukwanike make you enjoy your pure hustle in peace😂😂😂
“So una favorite Kayanmata girl with the plenty money couldn’t sustain her lifestyle again as kayanmata don cast, naso she run go meet abdushally say make that one loan am, as she see say that one sef get bogini bogini oko( big car of 45m) naso that one carry am waka go where them borrow am 15m to pay 18m oooo😂😂 them no collect any collateral for her hand as Instagram big girl now😂😂😂before you know it mama no gree pay money back ooo, matter don turn to yam pepper scatter scatter 😂😂person wey get money Dey hold abdushally , abdushally Dey hold omoshola, Na inspector general of police them take Dey pursue each other like this, from one writing of statement to another ni , the husband she got married to, that one see say she Dey flaunt money online, Na why that one come close, turn to Mario give am belle. as money don finish now Make everybody Dey look ni oo, who wan d!e jam who go kee am Na him be the matter , who go settle tins matter bayi, wo my Dear Legit business owner wey no Dey chase clout, you are doing well, Easy does it, SLOWLY but SURELY, e fit slow small oo but he go be, I don go😂😂igi ewedu oni wo pawa
“Note: Dey check our Instagram stories too as gbas gbos dey drop there too sometimes and the link off our other social media platforms is on our Instagram story presently, just a click, fiam you don reach there.”
Discover more from KossyDerrickent
Subscribe to get the latest posts sent to your email.